Friday 17 May 2013

Soccer Tori Breaker

Dis na wetin we dey use to dey separate one segment of the show to onoda

Thursday 16 May 2013

David Beckham don retire

As e be, David Beckham, England Captain bifor bifor wey don play 115 times for di contiri and also 394 times for Manchester United bifor dem sell am to Real Madrid. For Beckham, na plenti enjoyment as im play from Madrid to AC milan. Dat him waka take am over 10 year wey im take play for the 3 of di most ogbonge names for football for world. As Europe tire Beckham, na im ecome do wetin Pele and George Best no fit do during di time time wen dem dey play. Dat na to carri football go MLS go show dem serious gbege for dat side. As e come be, na wen Beckham waka come, na dat time MLS con get plenti respect for world. Chai!!! we go miss Beckham oo. All dose free kick wey dey bend like banana. Other players dem try to wan dey play am but dem no fit. In short, Beckham na di man. We hope say Beckham go fit start academi com dey teach young players dem. We hia say China government don dey hijack di bros make hin fit dey teach dem for dat side but we beg Beckham make him leave dem for China com Europe abi Africa where talent boku pass. Abeg my ogbonge pipul, make una dey take dis small video dey take dey remember David Beckham, di originator of Bending Free Kick

Tuesday 30 April 2013

Monday 29 April 2013

BETA NEWS FOR ARSENAL FANS? ARSENE WENGER WAN WAKA COMOT FROM ARSENAL!!!


Arsenal manager Arsène Wenger wan end him 17-year reign at north London club and move to Paris St-Germain

Paris St-Germain’s Qatari owners don yarn say dem dey sure say dem go fit steal Arsene Wenger comot from Emirates bifor di last year of him contract wit Arsenal. Wenger contract suppose end after 2014 season but PSG pipul no fit wait reach dat time as dia coach, Carlo Ancelotti don yarn dem say him dey comot go take over for Real Madrid wen season peme.


Exclusive: Arsène Wenger could be poised to end 17-year reign at Arsenal and move to Paris St-Germain

Di pipul for PSG don yarn say instead wey Arsen Wenger go dey coach small small boys dem, make him com bigin coach big boys like Lavessi, Pastore, Ibrahimovich, Beckham and dem dem like dat.

Dem even yarn say dem ready to put down beta money again dis season make di coach fit buy ogbonge players more wey go make di team to fit win cup for di continent nest season. 

We hia say Wenger dey consider di thin serious serious but wen journalist dem ask am make him touchlight di mata after Gunners play 1:1 wit Man United, him just yarn say " I know no wetin una dey talk, my aim be say I dey concentrate for Arsenal nest game and how dem go do wella for Europe nest season. Una also suppose know say for di age wen I be now, I no go wan go against my contract wit Arsenal"

Some pipul bin dey yarn am say Wenger contract wit Gunners be say di last year no de too important, if him wan waka, him fit waka. Na di cotract talk so.

We hope say Wenger go fit comot from Arsenal make di club fit get new direction. All of una Gunners fans, congratulobia in advance.